Tanzania President John Pombe Joseph Magufuli AKA “The Bulldozer” don die.
Di Vice President Samia Hassan Suluhu [now interim president] confam di death for one statement wey she issue live on national television network [Tanzania Broadcasting Corporation].
“Na wit deep regret I dey inform you say today… we lost our brave leader, di president of di Republic of Tanzania, John Pombe Joseph Magufuli,” Vice-President Samia Suluhu tok inside di announcement.
Magufuli die on Wednesday around 6.00 pm, Tanzania local time [15:00 GMT on 17 March, 2021], from heart complication, for Mzena hospital wey dey di commercial Capital, Dar es Salaam.
According to di Vice President, di Tanzania leader fall sick on di 14th of March and dem admit am for di hospital wia e die.
Magufuli bin get dis condition for more than 10 years.
Late John Pombe Magufuli AKA “The Bulldozer” die for di age of 61 years.
Di Vice President also announce say do kontri go get into 14-day period of mourning as arrangements for di burial dey go on.
During dis period, all flags for Tanzania go fly at half-mast, Hassan add.
You made some decent factors there. I looked on the internet for the issue and located most people will associate with along with your website.